Aids: na who be this
Ebola : bro na meooo,ur sis! i don show
Aids : which kind bad market be this nah, watin carry you come now nah?
Ebola : hmmmm bros why u dey yarn like dis nah? ya reign never do u? abio i hear say them don find cure for you.
Aids : so who give you transport come naija?
Ebola :bros na one man from liberia ooo. him say make i accompany am come naija.As we reach na him i carry leg leave am oooo.
Aids : so how u want operate?
Ebola : i go follow all the state wey get d same alphabet with ma name.....na for dos state i go operate.
Aids : oyah name the states......
Ebola : Ebonyi, Edo,Enugu,bayelsa,Bauchi,Benue,Borno,Oyo,Ondo,Lagos,Abia,Adamawa,Akwa Ibom,Anambra....
Aids : u b badoo, so out of 36 states you take only 15? sis u tyt,,,,me sef io wan upgrade nah, through air i wan carry d entire peepz....
Ebola : bro i bin hear say boko dey worry for north? i no wan dieooo
Aids : Market no dey move der againooo
lol.....just run for ya dear lifeooooooo

No comments:
Post a Comment